128
To Obey God Dey Pay
Solomon Song
Make una si di blessing wey dey follow doz wey dey fear
and do wetin God kommand.
Yu go enjoy wetin yu dey work for!
Yes! Yu go dey happy and sikure.
Yor wife go bi like vineyard wey get betta fruit
and e go prosper for yor house.
Yor shidren go bi like yong olive tree.
Yes! True-true, dis na God blessing for doz wey dey fear am.
Make God always dey bless yu from Zion.
As long as yu dey alive, yu go si Jerusalem dey prosper.
Yu go live to enjoy yor shidren-shidren.
Make peace always dey Israel land!