13
Prayer For Help
For Di Kwayamasta: David Song
My God, Yu go forget mi forever?
Na how long Yu go trowey yor face from mi?
How long I go dey struggol with pain inside my soul and get sorrow for my heart?
Na how long my enemies go always dey opress mi?
My Oga God, make Yu turn kon ansa mi!
Make yu give mi strent again or I go die.
Make Yu nor let my enemies dey make mout sey,
“Wi don win am!”
Den dem go dey happy sey I don fall.
But I trust yor love wey nor dey fail.
I go happy, bikos Yu don save mi.
Yes! I go sing to God,
bikos E don save mi.