14
As Man Wiked Rish
For Di Kwayamasta: David Song
Na only fools dey tok for dia heart sey, “God nor dey.”
Dem nor good at-all and dia ways bad well-well.
No one among dem dey do wetin good!
God dey look evribody from heaven;
E dey look to si if anybody really get sense and dey find am.
But e nor dey, bikos evribody don turn from am; evribody don spoil finish.
Nobody dey do good again.
Yes! E nor get anybody at-all.
Doz wey dey do bad nor go ever learn?
Dem dey chop my pipol like bread and dem nor dey pray to God.
So fear go katch dem,
bikos God dey with di pipol wey dey obey am.
Even doh wiked pipol dey fight poor pipol,
God go guide and protet dem.
E go from Zion kon save Israel pipol!
So wen God don save en pipol, Jakob shidren go shaut with joy
and Israel pipol go happy well-well.