15
Wetin God Wont
David Song
My God, na who go fit woship for yor temple?
Na who go enter yor present for yor holy hill?
Na doz wey dey live good life and do wetin dey rite;
pipol wey dey tok trut with pure heart.
Doz wey nor dey judge odas,
wound dia neighbours or tok bad about dia friends.
Doz wey hate pipol wey dey sin and honor doz wey dey fear and follow God!
Pipol wey dey do wetin dem promise even wen e dey pain dem.
Some pipol dey borrow money give odas without intrest and dem nor dey kollect bribe to lie for pesin head.
Di pipol wey dey do dis kind tins, go stand gidigba forever.