16
Prayer To Get Strong Mind
David Prayer
My God, make Yu protet mi,
bikos I don run kom meet Yu for help.
I tell my Oga God,
“Na Yu bi my Masta! Evry good and betta tin wey I get,
na Yu give dem to mi.”
Na doz wey dey fear God for dis land, I dey respet pass!
I dey happy to si and listin to dem.
Pipol wey dey run follow oda gods,
dia trobol dey plenty evriday.
I nor go follow dem do dia blood sakrifice
or even koll dia god name.
My God, na Yu dey make mi strong and prosper;
Yu don give mi betta future.
Evritin dey work for my good!
True-true, E don bless mi well-well.
So I go bless God wey dey guide mi;
even for nite, my heart dey happy to praiz am.
I don make God nomba one for evritin wey I dey do
and bikos E dey for my rite side,
I nor go shake or fear anytin.
No wonder happiness full my heart,
bikos I dey rest well and fear nor dey my life.
10 Bikos God nor go leave my soul inside grave
or allow en holy pikin rotin for der.
11 Yu don show mi di way wey dey give life
kon give mi joy for yor present
and I dey happy to stay with Yu forever.