132
Praiz For Di Temple
David Song
My God, make Yu remember David
and all di sofa wey e sofa.
E make promise give Yu
and E vow give di Oga wey bi Israel God sey,
“I nor go-go my house
or go sleep for my bed.
I nor go gri sleep
or let sleep katch mi
until I find di place where I go build God house put;
one big temple for di Oga God wey dey save Israel.”
Wi hear sey di Kovenant Box dey for Efrat;
den wi si am for Jaar town.
Make wi go God temple;
make wi woship am for front of en throne.
My God, make Yu raiz-up kon enter yor place where rest dey,
with di Kovenant Box wey dey show yor pawa.
Make yor glory kover yor priest;
make joy full yor loyal savants heart.
10 Bikos I bi yor savant,
make Yu nor rijet mi David, di king wey Yu choose.
11 God promise David di kind promise wey nor go shange sey:
“I go put one among yor shidren for di throne.
12 Den if yor shidren-shidren obey di kovenant and di laws wey I tish dem,
dem go bi king forever.”
13 Yes! God don choose Jerusalem;
E don choose di town as en own
14 and E sey, “I go dey rest for here forever.
I go stay der, bikos na mi choose am.
15 I go bless dis town kon make am prosper.
Den I go dey feed di poor pipol wey dey di land.
16 I go protet en priests
and joy go full di heart of doz wey dey fear God.
17 For der, I go make David pawa strong;
bikos I don decide sey, en shidren-shidren go bi king forever.
18 I go disgrace en enemies
and David kingdom go rule forever.”