133
To Show Love
David Song
Make una si as e dey good
and wonderful wen God pipol dey stay togeda for peace!
E dey bi like betta fine oil wey dem pour for pesin head,
wey rush go en bear-bear.
E rush go Aaron bear-bear
and di holy garment wey e wear.
E bi like di dew for Hermon wey dey flow from Zion hill.
True-true, na der God for sey en blessings go always dey forever and ever.