134
Make Wi Praiz God
David Song
All of una wey bi God savant and doz wey dey serve for God temple for nite,
make una praiz God.
Make una raiz una hand for di temple
kon praiz God!
Make God wey kreate heaven
and eart bless una from Zion!