135
Praiz Song
Make wi praiz Oga God! Make wi praiz God name!
Una wey bi God savant, make una gi-am praiz.
Una wey dey serve for di kourt
wey dey God temple;
make una praiz am, bikos E dey good!
Make una sing praiz en name,
bikos dat na wetin una suppose do!
True-true, God don choose Jakob as en own
and Israel pipol as en own pipol.
Yes! I know sey God dey great
and awa Oga God high pass oda gods.
E dey do anytin wey E like for heaven and eart,
both for under di sea and ocean too.
E dey make kloud raiz
kom from where di eart for end.
Na en dey bring tonda kom wons rain dey fall
and bring breeze kom out from where dem dey.
E kill all di first-born for Egypt,
both human being and animals.
E do great tins kon judge both Egypt,
Fero and all en savants just as dem deserve.
10 E distroy many nashons
kon kill mighty kings;
11 Sihon wey bi Amor pipol king
and King Og for Bashan and all di kingdom for Kanaan,
12 E give dia land to en pipol Israel,
as one special propaty.
13 So my God,
yor name go dey forever.
My Oga God, dem go respet Yu forever,
14 bikos Yu dey save yor pipol and sorry for yor savants.
15 Di gods wey human being dey serve,
na silva and gold dem take make dem.
16 Dem get mout, but dem nor fit tok;
dem get eyes, but dem nor dey si;
17 dem get ear, but dem nor dey hear
and dem nor dey breath at-all.
18 Pipol wey make dem, plus evribody wey trust dem,
go end up like dem.
19 So, Israel pipol, make una praiz God!
Aaron shidren-shidren, make una praiz God!
20 Levi family, make una praiz God!
Una wey dey do evritin wey God tok, make una praiz am!
21 E good make evribody for Zion,
praiz God and bikos na en bi God wey dey Jerusalem,
make all of us, praiz am!