136
Tanksgivin Song
Make wi tank God, bikos E dey good
and en love wey nor dey fail, dey forever.
Make wi tank God wey bi di oga of all gods,
bikos en love wey nor dey fail,
dey forever.
Make wi tank di Oga God of all ogas,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
Na-im bi di Pesin wey dey do wonderful tins wey dey sopraiz pipol,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
Di Pesin wey make di heaven with en wisdom,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
Di Pesin wey put di eart on-top wota,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
Di Pesin wey make di great lite for heaven,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever:
Di sun dey rule for day time,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever,
and di moon and star dey rule for nite,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
10 Di Pesin wey kill all di first-born for Egypt,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
11 Den E karry Israel pipol komot from der,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
12 E guide dem with en strong hand,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
13 Na-im divide di Red Sea, bikos en love wey nor dey fail,
dey forever.
14 Den E take Israel pipol waka pass di river for dry land,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
15 Na-im make Fero and en sojas die inside di Red Sea,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
16 Na God lead en pipol pass di wildaness,
bikos en love wey nor dey fail dey forever.
17 Di Pesin wey kill strong-strong kings for dem,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
18 E still kill great and mighty kings too,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
19 E kill King Sihon for Amor,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
20 E kill King Og for Bashan,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
21 Den E kon give dia land to en pipol,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
22 E give di land to Israel pipol wey bi en savant,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
23 Di Pesin wey dey remember and fight for us wen wi dey trobol,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever,
24 den kon take us komot from awa enemies hand,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
25 Di Pesin wey dey give food to evritin wey get life,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever.
26 So make wi tank di Oga God wey dey heaven,
bikos en love wey nor dey fail, dey forever!