137
Israel Pipol Song For Babilon
As wi sidan near Babilon River,
wi kon dey kry bikos wi dey tink about Jerusalem.
Wi trowey and hang awa harps
for poplar tree branches,
bikos na for der di pipol wey katch us, sey make wi sing Jerusalem song for dem;
dem even dey laf us kon sey make wi dey smile as wi dey sing am.
But how wi won take sing God song for land where di pipol
nor know God?
O-o my Jerusalem, if I forget yu, make my rite hand die,
so dat I nor go fit play harp again.
If I nor remember Yu again or si Jerusalem as where my joy from dey kom,
make my tongue gum my mout.
My God, make Yu remember wetin Edom pipol do wen dem
kon distroy and karry Jerusalem pipol komot from dia own land.
Dem dey shaut, “Make una skata Jerusalem rish groun!
Skata di town rish groun!”
Babilon pipol! God go soon distroy una.
Di pesin wey go pay una back for wetin una don do to us,
make happiness bi en own.
Di pesin wey go take una shidren dem take nak rock,
make blessing follow am!