138
Tanksgivin Prayer
David Song
My God, I tank Yu with all my heart;
I go sing yor praiz for where evry oda gods dey.
I bow kon woship Yu for yor holy temple.
I dey praiz yor name,
bikos of yor faithfulnes and love wey nor dey fail;
bikos Yu don make yor promise and e high pass di sky.
Wen I pray, na wons Yu dey ansa mi!
Yu enkourage mi kon give mi strent.
My Oga God, di king for di whole eart go tank Yu,
bikos all of dem go hear yor words.
Yes! Dem go sing about God ways,
bikos en glory dey great well-well.
Even doh God dey great,
E dey kare for di pipol wey dey honbol demsef,
but doz wey dey karry body up, e dey give dem shance.
Even doh trobol gada round mi,
Yu still kom save mi.
Yu protet mi from my enemies wey dey vex for mi
and yor rite hand kon save mi.
God go fight for mi.
My Oga God, yor love wey nor dey fail, go dey forever,
so make Yu nor rijet di pipol wey Yu kreate by yorsef.