140
Prayer To Protet
David Song
My God, make Yu save mi from wiked pipol!
Protet mi from pipol wey like wahala;
doz wey dey plan evil for dia heart
and dey kause trobol waka.
Dia tongue dey wound pipol like snake
and dia lips dey bring out snake poizin.
My God, nor let mi fall enter wiked pipol hand.
Make Yu protet mi from doz wey like wahala,
bikos dem dey plan bad against mi.
Proud pipol don set trap to katch mi; dem spread dia net
and dia trap dey evriwhere for di road.
So I tell Oga sey,
“Na Yu bi my God!”
So my Oga God,
make Yu listin wen I dey kry for help!
My God wey get pawa,
di strong One wey save mi,
na Yu protet mi wen my enemies dey fight mi.
So make Yu nor let wiked pipol win mi,
nor let dem susid with dia evil plan,
if not, dem go dey proud.
Make Yu distroy my enemies with di evil
and wiked tins wey dem plan for mi.
10 Make hot shako fall for dia head.
Make Yu trow dem for fire or inside pit wey wota dey,
where dem nor go fit komot or eskape.
11 Make Yu nor allow pipol wey dey lie,
prosper for dis land.
Make Yu kause betta wahala for doz wey like trobol.
12 But I know sey God go help di pipol wey dem dey opress
kon judge well for poor pipol.
13 True-true, pipol wey dey do wetin dey rite,
dey praiz yor name and doz wey dey fear God,
go stay for en present.