141
Prayer For Evening
David Song
My Oga God, I dey koll Yu, so make Yu kwik kom!
Make Yu listin wen I kry to Yu for help!
Make Yu asept my prayers like incense wey dem offa give Yu
and di hand wey I take dey praiz Yu,
asept am like ofrin wey pipol dey give Yu for evening.
My God, make Yu help mi kontrol my mout
kon guide my lips.
Nor let mi waka enter evil or follow pipol do bad tins.
Nor let mi chop sweet food wey wiked pipol kook.
Make pipol wey dey fear God beat and korrect mi with love!
Make my head nor rijet good oil!
True-true, even with all dia wiked plans,
my prayers dey make dem fear.
Wen dem trow dia leaders down from rock,
di pipol go kom listin to my word wey go diliver dem.
Just as pesin dey klear and dig groun,
na so too wiked pipol bones skata for dia grave mout.
But my Oga God wey get pawa, I dey look up to Yu.
Na Yu bi my guide; so make Yu nor let dem kill mi.
Make Yu keep mi from di trap wey dem don set for mi;
di hole wey wiked pipol dig.
10 Make Yu let wiked pipol fall enter dia own trap
and free mi from dia trobol.