142
Prayer For Help
David Song Wen E Dey Hide
I kry to God!
I dey beg make E kom help mi.
I tell am all my komplain
and trobols.
Wen I nor get pawa again,
na-im dey protet mi as I dey waka.
Bikos anywhere wey I dey go,
my enemies don set trap dey wait for mi.
I dey look for di rite pesin wey go kom help mi,
but nobody dey even tink go my side!
Nobody to help mi;
nobody even kare about wetin go happen to mi.
Den I pray to Yu, my Oga God kon sey,
“Na Yu dey guide mi.
Na Yu bi evritin wey I really wont for dis life.
Make Yu hear my prayers,
bikos I don taya.
Make Yu save mi from pipol wey dey opress mi,
bikos dem too strong for mi.
Bring mi kom out from prison,
so dat I go tank Yu.
Pipol wey dey fear God go kom gada round mi,
bikos Yu dey good to mi.”