144
Di King Tank God
David Song
I go praiz God wey bi my rock,
bikos na-im dey protet mi.
Na-im train my hand for war
kon give mi pawa to fight.
E love mi and E dey protet mi.
Na inside am I dey hide put
and na-im bi di Pesin wey dey diliver mi.
Na-im dey kover mi and di Pesin wey dey save mi.
Na God dey make pipol obey mi.
My God, na who wi bi wey Yu dey kare for us like dis?
Na ordinary human being Yu dey kare for so?
Wi just bi like air wey dem dey breath;
awa days bi like shadow wey dey fade go.
Oga God, make Yu open di heavens kon kom down.
Make Yu tosh di mountins, so dat smoke go kom out.
Make Yu shine yor lite kon skata yor enemies!
Make Yu shot yor arrow kon konfuse dem!
Kom down from heaven make Yu save mi;
kom save mi from di deep wota and from my enemies pawa.
Na lie-lie full dia mout; dem swear sey dem go tok di trut,
but na lie dem just dey lie.
My God, I go sing new song to Yu!
I go use jita wey get ten rope take sing and praiz Yu.
10 Bikos Yu don give yor kings viktory
kon save yor savant David from en enemies swod.
11 Save and diliver mi from my enemies pawa,
bikos na lie-lie full dia mout
and even doh dem swear sey dem go tok trut,
na lie dem still dey tok.
12 Make awa sons prosper for dia yong age
like betta plant wey dem put fertaliza.
Make awa dotas bi like betta pila
wey dem karve for palis.
13 Make difren-difren food full awa store house.
Make di animals wey dey awa land dey plenty more-more.
14 Make awa melu karry many propaty as dem dey kom.
Make no enemy break enter awa wall
kon katch us and make peace dey awa town.
15 Yes! Di pipol wey dis kind tin dey happen to, go happy!
True-true, doz wey God bi dia God, go happy well-well.