145
Praiz Song
David Song
I go honor Yu wey bi my God and King kon praiz yor name forever and ever.
I go praiz Yu evriday.
Yes! I go praiz Yu forever.
God dey great! Na only en wi suppose to dey praiz!
Nobody fit measure as E big rish.
Make evribody tell dia shidren-shidren about God mighty pawa;
make dem tok about evritin wey Yu don do.
I go always dey tink of yor majesty,
yor wonderful works and all yor mirakles wey yu do.
I go always dey tok about di wonderful tins wey Yu dey do
and I go tell evribody about di great tins wey Yu don do.
Evribody go tok di story about di wonderful tins wey Yu don do;
dem go sing with joy about yor raitiousness.
God get mesi and dey sorry for pipol!
E nor dey kwik vex and en love nor dey ever fail.
God dey good to evribody.
E dey sorry for evritin wey E kreate.
10 So Oga God, all yor works go tank Yu and di pipol wey bilive Yu,
go praiz Yu.
11 Dem go tok about di glory wey dey yor kingdom;
dem go tell pipol about yor pawa.
12 Dem go tok about di wonderful tins wey Yu don do
and about di majesty and glory wey Yu take dey rule,
13 bikos yor kingdom go dey forever and ever.
Yu dey rule from one generashon
go rish anoda.
14 God dey help pipol wey don fall
kon support doz wey dia load too heavy to karry.
15 So my God, evritin dey look up to Yu
and Yu dey give dem dia food wen dem wont am.
16 Wen Yu open yor hand,
doz wey dey hongry and nid wota,
Yu dey make dem beleful.
17 God dey rite for evritin wey E dey do;
na goodness full en body.
18 God dey klose to all di pipol
wey dey koll am for help;
Yes! E dey klose to evribody
wey dey koll am with klean mind.
19 Pipol wey dey fear am, E dey give dem wetin dem wont;
E dey hear wen dem dey kry for help kon save dem.
20 God dey protet all di pipol wey love am,
but E dey distroy wiked pipol.
21 So, I go praiz God
and make evribody for eart bless en holy name forever and ever.