146
Praiz God Wey Dey Save Us
Praiz God!
My soul, make yu praiz God.
I go praiz God as long as I dey alive.
Even if I dey die, I go sing praiz to God.
Make yu nor trust pipol wey get pawa;
bikos dem nor go fit help yu.
Wen dem don die,
dem go-go back to di groun and all dia plans go die with dem.
But pipol wey Israel God bi dia helpa and hope,
dey inside di Oga God and na joy dey follow dem.
Na God make heaven and eart, di sea and evritin wey dey inside dem.
E dey keep all di promise wey E make.
Pipol wey dem dey opress,
E dey judge dia kase well and dey feed doz wey dey hongry.
God dey free pipol wey dey prison.
God dey open blind pipol eyes
kon karry doz wey dey weak, go up.
God love pipol wey dey fear am.
God dey guide di strenjas among us.
E dey kare for pipol wey nor get papa and mama
and wimen wey dia husband don die,
but E dey ponish wiked pipol with dia wiked plans.
10 So God go rule forever.
Jerusalem pipol, E go bi una God
from one generashon go rish anoda.
So, make wi praiz awa God!