148
Make Evribody Praiz God
Make wi praiz God!
Make wi praiz God from heaven!
Make wi praiz am from di sky!
Make all en angels praiz am!
Make all di sojas for heaven, praiz am!
Make di sun and di moon, praiz am!
Make all di stars wey dey shine, praiz am!
Make di sky, praiz am!
Make all di wota wey dey di kloud for up, praiz am!
Make evritin wey God kreate, praiz am,
bikos E just kommand and evritin kon dey as dem dey.
E put dem for where dem dey forever and ever.
Nobody fit tok against en kommand.
Make all di tins wey dey inside di sea
and di ones for land, praiz God.
Make big-big stones with fire,
snow and kloud, wind and weda, obey am.
Mountins and all di hills;
trees and all di cedars;
10 wild animals and ordinary animal; animals
wey dey creep for groun and birds;
11 kings for di eart and all di pipol;
doz wey dey rule and judge di eart;
12 yong men and yong wimen; old men and shidren,
make all of dem praiz God.
13 Make all of dem praiz God name.
Bikos en name dey great and en glory dey shine
for di whole eart and for heaven!
14 E don make en pipol strong kon honor pipol wey dey obey am
and na dem bi Israel pipol wey dey klose to am.
So make wi praiz God!