149
Praiz Song
Make wi praiz di Oga wey bi awa God
kon sing new song to am.
Make wi sing praiz am
for where en pipol gada put.
Israel pipol, make una happy bikos of di Pesin wey kreate una.
Jerusalem pipol, make una praiz God well-well.
Make una dance praiz en name with sheke-sheke and jita,
bikos God like en pipol and doz wey honbol demsef,
E dey make dem win.
Make doz wey dey fear am, happy, bikos E go fight for dem!
Make dem shaut for joy as dem dey sleep for dia bed!
As dem hold swod wey get two mout for dia hand,
make dem praiz God,
so dat dem go fit revensh dia enemies
kon ponish di strenjas.
Dem tie dia enemies kings with shains
and dia priests with iron
and dem dey judge dem just as dem rite am.
God go fight for evribody wey dey serve am!
So make wi praiz di Oga wey bi awa God!