150
Praiz God
Make wi Praiz God!
Make wi praiz am for en temple;
make wi praiz am for di sky wey dey tok about en great pawa!
Make wi praiz am for di big-big tins wey E dey do;
make wi praiz am, bikos en greatness good pass evritin!
Make wi praiz am with trumpet sound;
make wi praiz am with jita and harp!
Make wi dance praiz am with sheke-sheke;
make wi praiz am with jita and flute!
Make wi dey nak cymbals togeda as wi dey praiz am.
Yes! Make wi praiz am with loud cymbals.
Make evritin wey dey alive, sing praiz God.
Make evribody praiz God!