18
David Viktory Song
David Song Wen God Save Am From Saul
My God, I love Yu well-well
and na Yu bi my strent.
Na God bi di rock wey dey protet mi.
Na-im dey guide mi and na-im bi di pawa wey dey save mi
and I dey save inside am.
I koll God wey get all di praiz
and E save mi from my enemies.
Deat dey round mi
and trobol won kill mi;
na so-so grave I dey dream about and na to die,
dey hongry mi.
But inside my trobol, I kry to God.
Yes! I pray to my God make E kom help mi
and E hear mi from en temple,
bikos my kry rish en ear.
Fear kon make di pipol for di eart dey shake.
Di mountins foundashon kon dey shake too;
dem dey shake bikos God dey vex.
Smoke dey kom out from dia nose;
fire dey pour kom out from dia mout with hot shako.
So, God open di heavens
kon kom down and dark kloud dey under en leg.
10 E sidan on-top angel feada kon fly go;
E fly go with strong breeze.
11 E kon hide ensef for darkness
and na di strong dark kloud E take round ensef.
12 Betta tick kloud kover di lite wey dey round am
and many stones and shako kon dey fall.
13 God vois from heaven bi like tonda
and evribody dey hear as di Most High dey shaut.
14 E shot en arrow kon skata en enemies and as en lite flash,
dem kon dey konfuse more-more.
15 Den as God kommand and as E just breath,
di sea bottom open and di eart foundashon kon dey show.
16 E kom down from heaven kon save mi,
den E drag mi kom out from deep wota.
17 E save mi from my enemies wey get pawa well-well;
from doz wey hate and too strong for mi.
18 Dem attack mi wen I dey trobol,
but God support and help mi.
19 E take mi go where dey save;
E save mi, bikos E love mi.
20 God reward mi, bikos I do wetin dey rite;
E bring mi kom back, bikos I dey innocent and
21 bikos I dey always keep en kommand.
I neva ever turn from my God kon follow evil.
22 I dey follow all en rules
and I neva ever rijet en laws.
23 For God present, I nor do any bad tin; I don keep mysef from sin.
24 God reward mi, bikos I do wetin dey rite.
E don si sey I dey innocent.
25 E dey show ensef sey E dey faithful to doz wey dey faithful
and to doz wey get respet,
Yu dey give dem respet.
26 To pipol wey get pure heart,
Yu dey show dem as Yu pure rish,
but to wiked pipol, Yu nor dey sorry for dem at-all.
27 Yu save gentol pipol,
but dey disgrace proud pipol.
28 Yu lite one lamp for mi.
Na di Oga my God put lite for my darkness.
29 With yor pawa, I fit kill many sojas.
With my God wey dey my side, I fit jump pass any wall.
30 God ways dey pafet and all en promise na true.
E dey guide evribody wey kom make E protet am.
31 Na who bi God escept God?
Na who again bi Solid Rock escept awa God?
32 God make mi strong with en strent
and E make my way strait.
33 E make my leg strong for groun like deer own
kon make mi fit stand on-top high mountins.
34 E train my hand, so dat I go fit fight war
kon bend even di bow wey strong pass.
35 My God, Yu don give mi wetin go protet mi.
Yor rite hand dey support mi and I don dey strong,
bikos of di way wey Yu dey help mi.
36 Yu don make betta road for mi,
so dat I nor go draw fall.
37 I porshu my enemies kon katch dem
and I nor stop until I distroy dem finish.
38 I kill all of dem finish
and all of dem fall under my leg.
39 Yu don give mi strent to fight war;
Yu don put my enemies under my leg.
40 Yu put my leg for dia neck
and I don distroy evribody wey hate mi.
41 Wen dem koll pipol to help dem, nobody gri kom.
Dem even kry to God, but E nor gri ansa dem.
42 I grind dem till dem turn to dust
kon swip dem enter gutta like dirty.
43 Yu make mi win doz wey dey akuiz mi.
Yu make mi rule oda nashons
and pipol wey I nor even know, dey serve mi.
44 Wons dem hear about mi, dem dey obey.
Strenjas and dia kountry pipol dey listin to mi.
45 Dem nor get strent again
and dem even dey fear for dia house.
46 God dey alive!
So, make praiz bi my Rock own
and I go bless my God wey save mi!
47 Na en bi di God wey dey ponish doz wey wound mi.
E put di nashons under mi
48 kon save mi from my enemies.
E keep mi for where my enemies nor go for fit tosh mi
kon save mi from wiked pipol.
49 Bikos of dis, I go praiz God among di nashons;
I go sing praiz to en name.
50 Yu don give betta viktory to yor king;
Yu don show yor love wey nor dey fail to David wey Yu anoint
and to en shidren-shidren forever.