19
God Work And En Glory
For Di Kwayamasta: David Song
Di heavens dey show as God glory bi.
Di sky dey show how en work big rish.
Dem dey show am evriday and for evry nite,
dem dey show en greatness.
Dem nor dey tok out
or sey pesin hear dia vois,
yet dia vois don rish evriwhere for di eart
and dia word don pass evriwhere for di world.
God don build house for di sun for heaven
and e dey shine kom out like man wey just marry.
E dey happy like pesin wey dey ready to run race.
Di sun dey kom out from one end for di heavens till e rish di oda end
and nor-tin fit hide from en heat.
God Law
God laws dey korrect and e dey save life.
Di laws wey God give us na trut
and dem dey give wisdom to pipol wey ready to learn.
God kommands dey rite
and e dey put joy for pesin heart.
En kommands dey klear and e dey give pesin hope
to stay for dis world.
To fear God dey good, bikos e dey give pesin hope forever.
God laws korrect and dem dey okay.
10 Dem betta pass silva and even gold wey fine well-well.
Dem sweet pass honey; even di honey wey dey fall from bee house.
11 Dem dey tish yor savant well and doz wey dey obey dem,
go get betta reward.
12 So God, how I won take know all my fault?
Make Yu klean mi from di bad tins wey I do wey I nor know.
13 Make Yu nor let mi do anytin wey nor good for yor eye
and nor let sin kontrol mi.
Den I go dey innocent and I nor go sin again.
14 My Oga God wey bi my Rock and Savior,
make di word from my mout and di tins wey I dey tink,
dey good for yor eye and sweet Yu well-well.