2
God Na King
Wetin make pipol wey dey dis world dey vex? Wetin make dem dey make plans wey go fail?
Di kings for di world gada with rulers kon dey plan against God and di king wey E choose.
Dem dey sey, “Make wi break di shains wey dem take shain us! Make wi free awasef from dia trap!”
But di King wey dey heaven dey laf dem anyhow.
Yes! God dey laf dem well-well.
So God kon vex tok to dem and dem bigin fear wen E sey,
“I don choose my king for Zion wey bi my holy hill.”
Den di king sey, “I go tell una wetin God kommand.
God tell mi sey: ‘Yu bi my pikin! Today, I don bi yor papa!
Make yu ask mi, and di pipol wey dey dis world, I go give dem to yu as yor propaty and evriwhere for di world, go bi yor own too.
Na iron rod yu go take break dem kon skata dem like pot wey dem mold with san!’ ”
10 So naw, una wey bi king, make una do wetin dey rite; una wey dey rule di world, make una dey take korreshon!
11 Make fear dey una heart as una dey serve God! Make una turn from sin kon meet God as una dey fear am!
12 Make una dey respet God well-well or E go fit vex kon distroy una at wons, bikos of di way una dey bihave.
But na blessing dey follow doz wey si am as dia Oga God!