3
Prayer For Help For Morning
David Song
My God, make Yu si as my enemies many rish!
Many of dem dey kom attack mi.
Many of dem dey sey,
“God nor go save am.”
But Yu, my God, na Yu bi di wall wey dey protet mi;
na Yu bi my glory and di pesin wey make mi dey alive.
Wen I kry to God for help,
E ansa mi from en holy hill.
I dey rest, sleep and wake-up well,
bikos God dey protet mi.
I nor dey fear,
even doh doz wey dey attack mi from evry korna,
plenty well-well.
My God, make Yu get up!
My God, make Yu save mi!
Yes, Yu go slap all my enemies for dia face kon break dia tit!
Viktory dey kom from God.
So, I dey beg Yu, God sey, make Yu bless yor pipol.