29
God Tok Inside Tonda
David Song
Make all di angels for heaven honor God;
make una honor am, bikos of en glory and strent.
Make una honor God, bikos en name get glory.
Make una woship God, bikos of en holiness.
God vois dey sound on-top di sea and en vois bi like tonda,
bikos na en bi di God wey dey kause tonda on-top strong sea.
God vois get pawa well-well;
en vois get glory.
God vois dey break mighty cedar tree!
Yes, e dey skata cedar trees for Lebanon.
E make Mount Lebanon dey shake like small animal
kon make Mount Hermon dey jump like small melu.
God vois dey kom with strong lite.
God vois dey make di wildaness shake.
Yes! En vois dey shake Kadesh Valley.
God vois dey bend big trees and skata leaf for forest.
Evribody for di temple dey sey,
“Make glory bi yor own!”
10 Na God dey rule ova wota
and E go bi king forever.
11 Na God dey give en pipol strent
and na en dey bless dem with peace.