30
Tanksgivin Prayer:
Song Wey David Take Dedikate Di Temple
My God, I go praiz Yu,
bikos Yu save mi and Yu nor let my enemies win mi.
My Oga God, I dey kry to Yu for help
and Yu don make mi well.
My God, Yu don bring mi kom out from grave.
Yu keep mi, so dat I nor go fall inside pit where dead body dey.
All of una wey dey fear God,
make una sing to am!
Bikos en vexnashon nor dey tey, but en favor dey last forever! Even doh I kry for nite,
I know sey joy go kom for morning.
Dat time wen I don get evritin wey I nid, den I go kon sey,
“Nor-tin go fit make mi poor again!”
But my God, wen yor favor don sikure mi like mountin,
Yu kon turn from mi and evritin wey I get kon skata.
My God, I dey kry
and beg Yu for mesi kon sey,
“Wetin Yu go gain if I die?
Wetin Yu go get if I enter grave?
Dead body go fit praiz Yu?
10 My Oga God, make Yu hear mi kon sorry for mi.
Make Yu kom help mi.”
11 Naw, Yu don turn my sorrow to happiness.
Yu remove di klot wey I take dey mourn
kon wear joy for my body like klot,
12 so dat I go sing praiz Yu and I nor go kwayet.
So, I go tank Yu wey bi my Oga and God forever!