33
Praiz Song
Una wey dey fear God, make una sing with joy;
bikos e dey good make pipol wey get pure heart, praiz am.
Make una praiz God with di sweet sound from jita;
make una use harp take sing to am.
Make una sing new song take praiz am;
make una play di harp make e loud well-well.
Bikos God word na true
and wi fit trust evritin wey E dey do.
E love anytin wey dey rite and good;
God love wey nor dey fail, full di eart.
Na with di word wey God tok, E take kreate di heavens.
E breath en word and all di stars for heaven, appear.
E gada di sea for one place
kon keep di ocean for where e dey.
So, make di whole world fear God and make evribody
kom bless en name.
Bikos na afta E tok, di world start!
As E kommand, di world kon appear at wons.
10 God skata di nashons plan
kon spoil wetin dem won do.
11 But God plan go stand forever;
wetin E plan,
nor go shange at-all.
12 Si as blessing full di nashon wey God bi dia God,
bikos God don take dem as en own.
13 God dey look from heaven.
E dey from der look all di pipol wey E kreate.
14 Evritin wey dey alive for dis eart,
God dey look dem from en throne.
15 Na-im make dia heart,
so E undastand evritin wey dem dey do or tink.
16 Just as di plenty sojas wey king get nor go fit save am,
na so too pesin pawa nor go fit save am.
17 So make yu nor feel sey na yor shariot go make yu win,
bikos with all en strent, e nor go fit save yu.
18 But God dey guide doz wey dey fear am;
doz wey bilive en love wey nor dey fail.
19 E save dem from deat
and keep dem alive wen honga dey.
20 Na God bi awa hope.
Na-im dey help and guide us.
21 Awa heart dey always happy,
bikos of am and wi trust en name wey dey holy.
22 My God, make yor love wey nor dey fail,
protet us, bikos na Yu bi di hope wey wi get.