34
God Good
David Song Wen E Pritend Sey E Dey Kraze And Abimelek Kon Porshu Am
I go always dey praiz God.
I go always dey tok about all di good tins wey E dey do.
Na only God name I go take boast;
so make doz wey dem dey opress, listin and happy well-well.
Kom make wi tok about how God great rish;
kom make wi praiz en name togeda.
I pray to God and E ansa mi
kon free mi from all my fear.
Doz wey dey go meet am make E help dem,
go happy well-well and shame nor go ever katch dem.
I pray to God as I dey sofa and E ansa mi;
E save mi from evritin wey dey worry mi.
Bikos na God angel dey guide mi,
na so too E dey protet and guide all di pipol wey dey fear am.
Make yu kom try God, den yu go si sey God dey good:
Make yu si as God bless di pipol wey bilive am!
Una wey bi God pipol, make una fear am,
bikos doz wey dey fear am go get evritin wey dem nid.
10 Yong lions wey strong well-well still dey hongry,
but doz wey trust God go get all di good tins wey dey dis world.
11 My shidren, make una kom listin to mi
and I go tish una how to fear God.
12 E get anybody wey won live betta life?
Anybody like to get long life?
13 Den make yu nor use yor mout take tok bad tin
and make yor lips nor dey lie!
14 Make yu turn from wiked tins kon do wetin dey good.
Make yu dey leave for peace with evribody
and do evritin to keep am like dat.
15 Pipol wey dey do wetin dey rite,
God eye nor dey komot from dia body
and en ear dey open to hear wen dem kry for help.
16 But God dey trowey en face from doz wey dey do bad tins;
E dey remove dem from dis eart.
17 God dey hear en pipol wen dem koll am for help.
E dey save dem from all dia wahala.
18 Pipol wey nor get hope, God dey-dey near dem;
E dey save doz wey dia spirit dey die.
19 Pipol wey dey do wetin dey rite, dey face trobol well-well,
but God go save dem from all dia wahala.
20 God dey protet en pipol well-well
and E nor go let any bad tin happen to dem,
21 but wiked pipol go must face wahala
and God go ponish doz wey hate en pipol.
22 God go save pipol wey dey serve am
and E nor go kondemn anybody wey dey obey am.