41
Man Wey Dey Sick, Prayer
David Song For Di Kwayamasta
Na blessing go follow doz wey dey do good for poor pipol!
God dey always save dem from trobol.
Make God protet and keep dem alive.
Make E make dem prosper for di land and save dem from dia enemies.
God dey kare for dem wen dem dey sick
kon make dem well again.
My God, I dey pray sey, “Make Yu sorry for mi.
Make Yu heal mi, bikos I don sin against Yu.”
Na only bad-bad tins my enemies dey tok about mi.
Dem dey ask, “Wen e go take die make pipol forget am?”
Dem dey visit mi like sey dem bi my friends,
but na wikedness full dia heart
and wen dem komot from where I dey,
dem go-go spoil mi give evribody.
Pipol wey hate mi dey tok for each oda ear about mi
and na only bad tins dem dey tink about mi.
Dem sey, “E get some bad-bad diziz.
E nor go ever get up from dat bed!”
Even my best friend, di one wey I trust with evritin;
pesin wey wi dey chop togeda, don turn against mi.
10 So Oga God, make Yu sorry for mi.
Make I well again, so dat I go pay dem back!
11 Like dis, I know sey I dey make belle sweet Yu,
bikos Yu neva let my enemies win mi.
12 Instead, Yu don keep my life, bikos I dey innocent;
Yu don let mi enter yor present forever.
13 So make una praiz di Oga wey bi Israel God,
bikos E dey alive forever and ever.
Amen!