42
Man Wey Dey Strenj Land Prayer
David Song Wey Korah Shidren Sing
My God, just as deer dey find wota to drink,
na so too I dey find Yu.
I dey hongry to know God!
Di God wey dey alive.
So na wen I go take stand for en front?
I dey kry both day and nite and na tears bi di only food wey I dey chop
and my enemies dey tell mi sey,
“Where dat yor God dey sef?”
I start to kry wen I remember as tins bi before!
Den I dey waka with doz wey dey woship God;
dey lead many pipol go God house
and wi dey happy as wi dey sing
and dey tank am as wi dey celebrate!
But wetin make mi nor get mind?
Wetin make my heart nor happy at-all?
I go put my hope for God hand!
I go praiz am again,
bikos na-im bi my Savior and my God!
Naw, I nor get hope at-all, but I go remember Yu,
even from Mount Hermon wey far
and for Mount Mizar land wey dey Jordan River.
I dey hear and si as wave for sea dey jam demsef!
Yor wave and breeze dey make my heart shake.
But evriday, God dey pour en love
wey nor dey fail for my life and evry nite,
I dey sing en song, dey pray to God wey give mi life.
I dey kry dey sey, “My God wey bi my rock,
wetin make Yu forget mi?
Wetin go make mi dey waka with pains
bikos my enemies dey opress mi?”
10 Dia wahala don break my bones.
Dem dey laf dey sey, “Where dat yor God dey sef?”
11 Wetin make mi nor get hope?
Wetin make my heart nor dey happy at-all?
But I go still put my hope for God hand!
I go still dey praiz am, bikos na-im bi my Savior and God!