43
Man Wey Dey Strenj Land Prayer
My God, make Yu show sey I dey innocent!
Save mi from pipol wey nor dey fear Yu.
Diliver mi from doz wey dey lie,
bikos na Yu bi di God wey dey save mi.
But wetin make Yu rijet mi?
Why I go dey waka with pains, bikos my enemies dey opress mi?
Make Yu send yor lite and trut kon guide mi.
Make dem karry mi go yor holy mountin, di place wey Yu dey stay.
For der, I go-go God altar;
di God wey dey give mi joy kon praiz am with my harp!
Wetin make my soul dey weak?
Wetin make my heart nor happy at-all?
But I go put my hope for God hand!
I go praiz am again,
bikos na-im bi my Savior and God!