45
Song For Royal Marriage
David Love Song
Na betta words full my heart for di king and I go use my vois praiz am,
just as dem dey use biro rite for book.
Na yu fine pass among evry oda man!
Betta word dey kom out from yor mout
and bikos of dis, God ensef don bless yu forever.
My strong warrior!
Make yu karry yor swod kon appear with yor glory and majesty!
Make yu appear with yor majesty kon ride go defend wetin dey rite, true and good.
Dat time, Yu go win yor enemies with yor strong rite hand.
Yor arrows sharp, e dey shuk yor enemies for dia heart
and nashons dey fall for yor leg.
My God, yor throne go dey forever and ever.
Na with royal pawa Yu take dey judge yor kingdom.
Yu love wetin dey rite kon hate wiked tins.
So Oga wey bi yor God don anoint yu as E pour en oil for yor head
kon make yu high pass any oda pesin.
Na myrrh, aloe and kassia dem spray as perfume for yor klot.
Dem dekorate yor palis with ivory
and na harp dem take dey entertain yu for der.
Kings dota dey join doz wey kom visit yu
and yor kween go wear fine-fine gold
and silva wey dem make for Ofir town
kon stand near yu for yor rite side!
10 All my princess, make una listin to mi kon keep wetin I tok for una heart.
Make una forget una pipol and family wey dey far-far.
11 Bikos una prince dey happy for una beauti.
Make una honor am, bikos na-im bi una oga.
12 Rish pipol from Tyre town go kom give una gifts.
Doz wey get money go kom make una help dem.
13 Di king dota dey always dey happy for en room afta e don wear en fine-fine klot
wey dem make with gold.
14 Den dem go take am go meet di king
as e wear di fine klot with di virgins wey follow am for back
15 and dem go happy dey celebrate
as dem dey enter di king palis!
16 Dia sons go bi king afta dia papa
and dem go rule ova many lands.
17 I go make evry generashon honor and remember yor name
and pipol go praiz yu forever and ever.