46
God Dey With Us
David Song Wey Korah Shidren Sing
Na God bi di strong place wey wi dey hide put
and na-im dey help us wen wi dey trobol.
Bikos of dis, wi nor dey fear wen di eart dey shake
or wen mountins dey fall enter sea.
River dey make betta nois
and mountins dey shake for di strong sea.
Di wota from di river dey bring joy kom God town;
di special and holy place where di Holy One dey stay.
Bikos God dey stay di town, e nor go skata.
Na from wen day just break, God dey protet am.
Nashons don skata and dia kingdoms dey fall!
God shaut like tonda and di eart kon bigin melt!
God wey dey lead heaven sojas dey with us
and na Israel God dey protet us.
So make una kom si all di wonderful tins wey God don do.
Make una si how E dey make di world konfuse.
E stop all di war for di eart kon break di bow and skata di spear,
den E burn di shield with fire.
10 God sey, “Make una stand for where una dey,
den una go know sey na mi bi God!
Evry nashon go honor mi
and evribody for di world go praiz my name.”
11 God wey dey lead heaven sojas dey with us
and na Israel God dey protet us.