47
Na God Dey Rule Di World
David Song Wey Korah Shidren Sing
Evribody! Make una kom!
Make una klap una hand!
Make una shaut praiz God with klean mind!
Bikos di Most High dey good!
Na-im bi di great King for di whole eart.
E distroy di pipol wey dey before us
kon put awa enemies under awa leg.
E choose and give us di Promise Land as awa propaty for life;
di place wey dey make Jakob shidren-shidren happy;
di shidren wey God love.
God dey waka go en throne
and pipol dey shaut and blow trumpet as E dey go.
So, make una sing praiz God; make una praiz am;
make una sing praiz to awa King, make una sing praiz am!
Na God bi di King for all di eart.
Make una praiz am with psalms!
Na God dey rule all di nashons,
even as E sidan for en holy throne.
Di rulers for di world gada togeda with Abraham and God pipol,
but bikos na God bi di King of evry king,
make una honor am for evriwhere for di world.