48
Zion: God Town
David Song Wey Korah Shidren Sing
Si as awa God great rish!
Wi go praiz am for en own town wey dey on-top en holy mountin!
Di mountin dey high and fine well-well;
di whole eart dey happy to si am!
Mount Zion wey bi di holy mountin,
na-im bi di town where di great King dey stay!
God ensef dey for Jerusalem towa
and na-im dey defend us.
Di kings for di eart join togeda kon fight di town.
But wen dem si am, dia heart kut and fear katch dem,
so dem kon run go back.
Fear katch dem well-well
and dem kon dey kry with pain like woman wey won born.
Yu skata dem like di big sheep for Tarshish
wey Yu distroy with di wind from east.
Wi don hear about di town glory, but naw, wi don si am by awasef;
di town wey God wey dey lead heaven sojas, dey
and bikos na awa God town,
E go protet am forever.
My God, as wi dey woship for yor temple,
wi go always dey tok about yor love wey nor dey fail.
10 My God, as yor name bi, na so dem go praiz Yu for evriwhere for di eart.
Na viktory full yor strong rite hand.
11 Make Zion pipol rijoice.
Make all di towns for Judah happy, bikos of di way God dey judge.
12 Make una go look Jerusalem;
waka round and kount all di towas.
13 Make una si as di town walls strong rish and as e dey save,
den una go fit tell una shidren-shidren about am.
14 Bikos na so God bi!
Na-im bi awa God and E go guide us forever and ever.