49
E Dey Foolish To Trust Money
David Song Wey Korah Shidren Sing
Evribody, make una listin to wetin I won tok!
Evribody for di world, make una put una ear for groun!
Pipol wey get money and pipol wey nor get, make una listin!
Bikos wetin I dey tok, dey good and wetin I dey tish,
dey give pipol wisdom.
I go listin to many proverbs
and play jita take solve many problems.
So, wetin go make mi fear wen trobol kom
or wen enemies gada round mi?
Dem bilive dia money
kon dey boast with all di tins wey dem get.
Yet dem nor fit save demsef from deat
or pay God for dia life:
(true-true, e nor get any money wey pesin fit take buy human being life,
bikos evribody must die)
since dem nor go dey alive forever, bikos dem go must die one day.
10 Wi know sey even wise pipol must die;
both fools and doz wey dey spiritual still dey die too
and na odas go kollect evritin plus di money wey dem get.
11 Dia grave go kon bi where dem go stay forever.
Dem give dia land dia name,
12 but with all di money wey dem get, dem must still die;
dem bi like animals wey dey die trowey.
13 Dis na wetin go happen to fools
and pipol wey bilive wetin dem dey tish.
14 Just as sheep dey waka like mumu,
na so too dem go dey waka until dem enter dia grave;
di place where Deat go bi dia shepad and oga.
For morning, pipol wey dey fear God go rule ova dem.
Dia body go rotin for grave wey nor even dey near dia fine house.
15 But for mi, God go save my life.
E go save mi from deat.
16 So make wi nor dey judge or vex
bikos wiked pipol get money or get fine house.
17 Bikos wen dem die, dem nor go take anytin follow body.
Dia money and evritin wey dem get, nor go follow dem enter grave.
18 For dis life, dem dey happy sey dem get evritin
kon dey klap for dia suksess,
19 but dem go die like doz wey don die before
and dem nor go ever si day lite again.
20 Pipol wey dey make mout about dia money,
nor undastand anytin at-all;
bikos dem go die, just as animal dey die too.