50
True Woship
Asaf Song
Di Almighty One wey bi God don tok;
E don gada evribody
rite from where di sun for dey raiz
go rish where e for dey go down.
From Mount Zion wey fine well-well,
God dey shine inside en glory.
Awa God dey kom and E nor dey kwayet at-all.
Fire dey burn evritin wey dey en way
and strong breeze wey dey make nois, dey round am.
E dey koll di heavens wey dey up and di eart wey dey under,
so dat dem go bi witness wen E dey judge en pipol.
E sey, “Make una bring my pipol wey dey obey mi kom,
doz wey make kovenant with mi with dia sakrifice.
Make di heaven tok about how E take dey judge
bikos na God go judge by ensef.
Make di heavens tok about en good judgement,
bikos na God bi di judge.
My pipol, make una listin as I dey tok.
Israel pipol, dis na wetin I get against una,
na Mi bi di Oga wey bi una God!
I nor dey komplain about una sakrifice
or di burnt ofrin wey una always dey offa.
I nor nid di melu from una house again
or wont di goat from una farm.
10 Bikos na mi get all di animals for forest
and all di many goats wey dey di hills.
11 I know all di birds for di mountin
and all di animals for di field, na my own too.
12 If to sey I dey hongry, I nor go tell una,
bikos na mi get di world and evritin wey dey inside.
13 I dey chop melu meat?
Abi I dey drink goat blood?
14 So make tanksgivin bi una sakrifice to God,
den make una keep di promise wey una make to di Most High.
15 Afta, make una koll mi wen una dey trobol and I go kom save una,
den una go give mi all di glory.”
16 But God tell wiked pipol: “Wetin make una dey learn my laws
and dey pritend sey una dey obey my kovenant?
17 Una nor gri listin to my kommand,
instead una dey do my word anyhow like dirty.
18 Wen una si tifs, una go hail and klap for dem
and una dey spend una time with pesin
wey dey sleep with who e nor marry.
19 Na so-so wiked tins full una mout
and na lie-lie full una tongue.
20 Una go just sidan dey tok bad about una broda;
di pikin wey una own mama born.
21 As una dey do all dis tins,
I nor tok at-all and una feel sey I nor kare.
But naw, I go distroy una
kon rite evritin wey I get against una.
22 All of una wey don forget mi, make una turn from sin kom meet mi
or I go kill una finish and nobody go kom help una.
23 But to dey give tanks,
na di kind sakrifice wey dey sweet mi for body.
So if una follow my kommand,
I go show una how God salvashon bi.”