58
Make God Ponish Wiked Pipol
David Song For Di Kwayamasta
Una wey dey rule, una dey judge well?
Una dey judge di pipol well so?
No! Na bad tins una dey plan for una mind
and na wahala una dey kause for di whole town.
Dem born dis wiked pipol with sin for dia heart;
na from dia mama belle dem don start to lie and do as dem like.
Dia spit bi like wiked snake own;
dem bi like kobra wey nor dey hear word;
bikos dem nor won hear di nois wey di pesin
wey dey sharm snake, dey make.
So my God, make Yu break dia tit!
Make Yu skata di lion jaw.
Make dem vanish like wota wey dey flow!
Make dem dry like grass wey pipol go burn trowey!
Make dem bi like snail wey dey die as dem dey waka!
Make dem bi like pikin wey dem just born,
wey nor ever si sun before e die!
God go swip dem trowey kwik-kwik,
even before pot wey dem put for fire, go dry.
10 Pipol wey dey fear God go happy wen dem si wiked pipol dey fall.
Dem go use wiked pipol blood take wosh dia legs.
11 Den for di end, evribody go sey,
“Yes! Pipol wey dey obey God, go get dia reward.
True-true, wi get God wey go judge di whole world!”