59
Prayer To Dey Save
David Song Wen Saul One Kill-am
My God, make Yu save mi from my enemies.
Make Yu protet mi from di pipol wey won kill mi.
Save mi from pipol wey dey do bad tins
and doz wey like wahala well-well.
My God, si as dem dey wait for korna to katch mi;
wiked and strong men dey wait to katch mi,
even doh I nor sin or do bad tin.
I nor do anytin bad, yet dem dey wait to attack mi.
Make Yu raiz-up kon si wetin dey happen, den help mi!
My Oga wey bi kommander for heaven, Israel pipol God,
make Yu raiz-up kon ponish doz wiked nashons.
Make Yu nor sorry for wiked pipol.
Dem dey waka round di town for nite
like wiked dogs.
Make Yu listin to how dem dey curse mi
and even for publik, dem dey treaten to kill mi dey sey,
“Afta wi don finish with yu, nobody go shalenge us!”
But Oga God, dey laf dem.
Yu dey laf all dis wiked nashons.
Na Yu bi my strent and I dey wait make Yu save mi!
Na Yu God, bi my guide!
10 My God wey love mi go help mi.
E go make mi happy, bikos I win my enemies.
11 Make Yu nor kill dem just like dat,
bikos my pipol go kwik forget di lesin.
So, make Yu use yor pawa take
make dem dey waka up-and-down without house,
den make Yu honbol dem,
bikos na Yu my God, dey protet mi.
12 Bikos of di bad-bad tins wey dem dey tok, bikos of di evil wey dey dia lips,
make dia own pride, bad mout and lie-lie, trap dem.
13 Make Yu distroy dem as Yu dey vex!
Make Yu distroy dem finish!
Den di whole world go know sey God dey reign for Israel.
14 My enemies dey kom out for nite
like wiked dog wey dey waka about for street.
15 Dem dey find food to chop and even wen dem si chop,
di food nor dey rish dem.
16 But for mi, I go sing about yor pawa.
Evry morning, I go sing with joy about yor love wey nor dey fail,
bikos na Yu bi my guide;
di place where I dey hide wen trobol kom.
17 Na Yu dey give mi strent,
so I go sing praiz to Yu.
Na Yu dey guide mi;
di God wey show mi en love wey nor dey fail.