61
Prayer For Proteshon
David Song For Di Kwayamasta
My God, make Yu hear as I dey kry!
Make Yu hear mi as I dey pray for help!
From di end of di eart, I kry kom meet Yu for help,
bikos trobol don make my heart heavy.
Karry mi go di high mountin,
where I go for dey save.
True-true, na Yu dey save mi;
my strong towa wey dey protet mi from my enemies.
Make Yu let mi stay yor temple forever,
den I go dey save under Yu.
Yu know wetin I promise
and Yu don give mi di reward
wey Yu dey give pipol wey dey obey Yu.
Mi wey bi king, make Yu give mi long life,
so dat I go si my shidren-shidren!
Make di king rule with God proteshon forever.
Make yor love wey nor dey fail and faithfulnes, keep di king.
Den, I go dey sing praiz yor name forever
kon dey do wetin I promise Yu.