62
Bilive God For Proteshon
David Song For Di Kwayamasta
I dey kwayet dey wait,
bikos na God dey diliver mi.
Na-im bi my Rock and Salvashon;
di place where I dey hide put and I nor go fear or shake.
How long una go dey treaten one man?
All of una dey kill pipol and una bi like wall wey don break
or fence wey get mark wey go soon fall.
Dem dey spend all dia time dey plan how dem go take finish mi.
Dem dey happy to lie about mi.
Dem dey praiz mi for my present,
but for dia heart, dem dey curse mi.
But my soul and body dey kwayet dey wait for God,
bikos na-im dey make my heart strong.
Na-im bi my Rock and Salvashon;
di place where I dey hide put and I nor go fear or shake.
My viktory and honor dey kom from God.
Na-im dey guide mi and na-im bi my Rock,
so nobody fit kom attack mi for der.
My pipol, make una always dey trust God,
bikos na en dey guide us.
Human being bi like ordinary dirty wey breeze dey blow
and pipol wey feel sey dem strong,
nor get pawa at-all.
If yu go measure dem for skale,
all of dem togeda nor heavy rish air.
10 So, make yu nor trust wetin yu get thru opreshon!
Nor put hope for wetin yu tif!
If yor money many, make yu nor too happy.
11 God don tok many times sey,
“All di pawa for heaven and eart, dey my hand
12 and my love nor dey fail.”
True-true, God go pay evribody
akordin to wetin dem do.