7
God Dey Judge Well
David Song About Benjamin And Kush Pipol
My Oga God, I don kom meet Yu make Yu protet mi.
So make Yu save mi from doz wey won kill mi!
If Yu nor save mi, dem go chop mi like sey dem bi lion
and nobody go fit save mi.
My Oga God, if I don do any wrong tin
or dey guilty as dem tok;
if I sin against my friend
or ponish my enemies wen dem nor do anytin against mi,
den make my enemies porshu and katch mi.
Make dem mash mi die kon trowey my body for groun.
My God, make Yu vex raiz-up for mi, den kon fight my enemies!
Abeg, raiz-up make Yu kom fight for mi!
Pipol for di world gada round Yu,
so make Yu rule dem from yor throne.
Bikos na Yu dey judge evribody,
make Yu show sey I dey good,
bikos true-true,
I dey innocent and na Yu bi di Most High God!
Make Yu stop di bad tins wey wiked pipol dey do kon defend doz wey dey good,
bikos my God wey dey good, know wetin dey pipol mind and heart.
10 Na God bi my guide!
E dey save doz wey get klean and true heart.
11 God dey judge well.
E dey vex for wiked pipol evriday.
12 If pesin nor gri turn from sin kom meet God,
God go sharp en swod kon ready to shot en bow.
13 E go ready en swod wey dey kill
kon shot en arrow wey dey hot like fire.
14 Pesin wey karry wikedness
and bad plans for belle,
dey born lie-lie.
15 E dey dig deep pit for odas,
but na en ensef dey fall enter
16 and di trobol wey e plan for odas,
dey fall for en own head.
Na en own wahala dey
kause trobol for am.
17 So, I go tank God, bikos E dey judge well;
I go sing and praiz di Most High God.