8
God Glory And Man Honor
David Song
Oga awa God, yor greatness full di whole world!
Yor glory high pass di heavens.
Yu don tish shidren and small pikin,
so dat dem go fit tok about yor pawa
and how Yu take silent yor enemies and doz wey dey oppoz Yu.
Wen I look di sky for nite kon si di work wey Yu do;
di moon and di stars wey Yu keep for dia place,
I dey ask mysef,
“Wetin pipol bi wey Yu dey tink about dem?
Na ordinary human being Yu dey kare about?”
Yu make dem bi like Yu
kon give dem glory and honor.
Yu sey make dem kare for evritin wey Yu kreate,
bikos Yu put evritin under dia kontrol;
all di animals,
both wiked and di ones wey nor wiked,
di birds for di sky, di fish for sea
and evritin wey dey swim for wota.
Oga awa God,
yor greatness full di whole world.