9
God Korrect Judgement
For Di Kwayamasta: David Song
My God, I go tank Yu with all my heart;
I go tok about all di wonderful tins wey Yu don do.
I go sing with joy bikos of Yu.
Di Most High God,
I go sing praiz yor name,
bikos as my enemies si Yu,
dem stagga fall kon die.
Naw, yor judgement don favor mi
and Yu don judge well from yor throne.
Yu make di nashons dey fear kon distroy wiked pipol,
den Yu remove dia name from yor book forever.
My enemies don die finish forever;
di towns wey Yu rut komot from groun,
dem nor go ever remember dem again.
But God go reign forever
and E go dey judge from en throne.
E go judge di world well
kon rule di pipol with betta mind.
Na God dey guide doz wey dem dey opress;
na-im dey save dem wen trobol kom.
10 Doz wey dey loyal to Yu,
dey trust Yu,
bikos Yu nor dey leave doz wey wont make Yu help dem.
11 E good make wi sing praiz to God wey dey rule from Jerusalem.
Make wi tell di world all di tins wey E do,
wey dem nor fit forget.
12 Bikos di Pesin wey dey ponish doz wey kill pipol,
still dey kare for doz wey nor get helpa.
E nor dey leave pipol wey dey sofa.
13 My Oga God, make Yu sorry for mi.
Si as my enemies dey trobol mi,
so make Yu kom take mi komot from deat mout.
14 Save mi so dat I go fit praiz Yu for publik for Jerusalem gate.
Yes! I go dey happy bikos Yu don save mi.
15 Wiked pipol don fall enter di pit wey dem dig for odas.
Di trap wey dem set, don katch dia own leg.
16 Dem don know God naw,
bikos E dey judge well and naw,
wiked pipol dey fall enter dia own trap.
17 Wiked pipol go die enter grave.
Dis na wetin go happen to all di pipol wey rijet God.
18 But God nor go forget doz wey dey kry for help.
E nor go live dem forever;
E go always dey give poor pipol hope.
19 My Oga God, make Yu raiz-up!
Nor let wiked pipol win!
Make Yu kom judge di nashons.
20 Make dem fall with fear.
Make Yu let pipol know sey,
na ordinary human being dem bi.