78
God And En Pipol
Asaf Song
My pipol, make una listin to wetin I dey tok.
Make una open una ear, so dat una go hear wetin I dey tell una,
bikos na parabol I go take tok to una.
I go tish una about some tins
wey don happen before;
story wey awa grand-grand papa
dem tell us.
Wi nor go hide dis trut from awa shidren;
wi go tell di next generashon about di good-good tins wey God do,
en pawa and di wonderful tins wey dey sopraiz us.
E give law to Jakob shidren kon tell en pipol Israel,
wetin dem go do.
E still kommand awa grand-grand papa
sey make dem tish di laws to dia shidren,
so dat di next generashon go know;
even di shidren wey dem neva born
and dis ones too go tish dia own shidren.
So evry generashon go get hope and trust God
and dem nor go forget en great mirakles,
but dem go obey en kommand.
Dem nor go bi like dia grand-grand papa wey sturbon;
pipol wey nor gri obey, listin or give dia heart to God.
Efraim sojas, even doh dem get bow and arrow,
wen war start, dem go run,
10 bikos dem nor gri keep God kovenant
or obey en kommandment.
11 Dem forget wetin E don do,
di great wonders wey E show dem,
12 di mirakles wey E do for dia grand-grand papa
for Zoan wey dey for Egypt.
13 For der, E divide di sea
kon take dem pass as di wota stand up like wall!
14 E dey lead dem with kloud for day
and pila wey get fire for nite.
15 E tear rock open
kon give dem wota drink for wildaness!
16 E make wota kom out from di rock
and e kon dey flow like river!
17 Yet dem still dey sin against am;
dey disobey di Most High for di desert.
18 Dem dey test God with sturbones for dia heart
kon dey tok di kind food wey dem won chop.
19 Dem even tok against God ensef wen dem sey,
“God nor fit give us food for di wildaness.
20 Yes! E fit nak rock make wota kom out,
but E nor fit give en pipol bread and meat.”
21 Wen God hear dem, E vex well-well.
Di fire from en vexnashon kon dey against en pipol.
Yes! En vexnashon kon strong well-well,
22 bikos dem nor gri bilive God
or trust sey E go kare for dem.
23 But E kommand di sky make e open,
den E open di doors for heaven.
24 E send manna kom down so dat en pipol go si food chop;
E give dem bread from heaven.
25 Dem chop food wey angels dey chop
and God give dem enough to chop.
26 God release di east wind for heaven
kon guide di sout wind with en pawa.
27 E send meat like dust go give dem
kon still give dem birds wey plenty like san-san wey dey wotaside!
28 E make di birds dey fall
for evriwhere for dia kamp
and for dia house
29 and di pipol chop beleful.
E give dem wetin dem ask for.
30 But before dem even beleful,
as di meat still dey dia mout,
31 God kon dey vex for dem and E kill all dia strong-strong men.
E kill Israel yong men wey fine pass.
32 But even as all dis tins dey happen, di pipol still dey sin.
With all dis mirakles, dem nor gri trust am.
33 So E kon make dem die with disgrace
and dia years kon end with shame.
34 Wen God dey kill dem, dem kon dey beg make E sorry for dem.
Dem turn to God kon take am sirious.
35 Den dem remember sey na God bi dia rock;
sey na di Most High God save dem.
36 But dem dey lie give God
kon dey tok anyhow.
37 Dia heart nor dey loyal to God
and dem nor gri keep en kovenant.
38 Yet, God sorry for dem kon forgive dem dia sins and E nor distroy all of dem.
So, E nor dey too vex for dem or show en vexnashon,
39 bikos E remember sey na ordinary human being dem bi.
Dem go just die go like breeze wey nor dey kom back again.
40 Dem sin against am many times for di wildaness
kon make am vex for dat dry dirty land.
41 Dem always dey test and shalenge God.
Dem dey make di Holy One for Israel dey vex.
42 Dem nor remember en pawa
and how E save dem from dia enemies.
43 Dem nor remember all di mirakles wey E do for Egypt;
di wonders wey E do for Zoan field,
44 bikos E turn Egypt river to blood,
so dat nobody go fit drink di wota.
45 E send many fly kon attack dem
and many frog skata dia land.
46 E allow katapiller chop dia plants
and lokust chop all dia seed.
47 E distroy dia grape vine with big-big stones
kon skata dia sykamore-fig tree.
48 E kill and distroy dia animals with big-big stone
and strong tonda.
49 E show dem en great vexnashon and anga.
E send angels wey dey distroy tins go meet dem.
50 E turn en vexnashon face dem.
E nor sorry for Egypt pipol life,
but E use strong wahala take distroy dem.
51 E kill all di first sons for Egypt family;
all di first sons wey Egypt pipol born.
52 But E lead en own pipol kom out like many sheep
kon guide dem pass di wildaness.
53 E guide and keep dem as dem dey go;
but di sea kill dia enemies.
54 E bring dem kom di borda for en holy land;
di hill lands wey E don win for dem.
55 E porshu di nashons wey dey before dem
kon divide dia propaty give en pipol.
E make Israel pipol relax for dia house.
56 But Israel pipol still dey test and sin against di Most High God
and dem nor gri obey en laws.
57 Dem turn back and dem nor kon get faith like dia papa and mama.
Yu nor fit put hope on dem, bikos dem bi like bow wey don spoil.
58 Dem dey make God vex as dem dey build shrine for oda gods;
dem really make God jealous with dia juju.
59 Wen God hear dem,
E kon dey vex and E really rijet Israel pipol.
60 Den E leave en place for Shiloh,
di Tabanako where E bin dey stay with en pipol.
61 E allow enemies karry en Kovenant Box
kon give dem en glory.
62 E give en pipol to enemies make dem kill dem with swod,
bikos E dey vex well-well with di pipol wey E love well-well.
63 Na fire kill dia yong men
and dia yong wimen die even before dem sing dia wedding song.
64 Dem kill dia priests and wimen wey dia husband don die,
nor fit mourn for dem.
65 Den God raiz-up like sey E just dey wake from sleep;
like strong soja wey en eye just klear from drink.
66 E skata en enemies kon disgrace dem forever.
67 But E rijet Josef shidren-shidren
and E nor gri support Efraim tribe again.
68 Instead, E choose Judah tribe and Mount Zion wey E love.
69 E build temple wey high like heaven
kon strong like di eart, den E put am for der.
70 E choose David en savant,
wen E koll am from where e for dey kare for sheep.
71 E take David from where e for dey kare for animals
kon make am leader among Jakob shidren-shidren,
wey bi Israel God own.
72 E kare for dem with betta mind
kon save dem with en strong hand.