79
Prayer For Di Nashon
Asaf Song
My God, strenjas don take di land wey Yu choose as yor own.
Dem don spoil yor holy temple kon turn Jerusalem
to where dem dey pour dirty put.
Dem don kill yor savants kon leave dia body for groun make bird chop dem.
Doz wey dey fear Yu, dia flesh don turn food for wild animals.
Blood dey flow like wota for evriwhere for Jerusalem
and nobody remain wey go beri doz wey dem kill.
Awa neighbours dey laf us; pipol wey dey around us,
dey take us make yeye.
My God, na how long Yu go dey vex with us?
Na forever? Na how long yor vexnashon go dey burn like fire?
Make Yu pour yor vexnashon for di nashons wey nor dey respet Yu;
di kingdoms wey nor dey koll yor name,
bikos dem don finish yor pipol Israel
kon turn di land to dirty and empty wildaness.
Make Yu nor kount awa grand-grand papa dem sin against us
and bikos Yu dey sorry for pipol,
make Yu kwik-kwik kom ansa us,
bikos e remain small make wi die finish.
My God wey dey save us, make Yu kom help us!
Make Yu forgive us, bikos of di glory wey dey yor name.
10 Wetin make Yu allow wiked pipol even get mout to ask sey,
“Where dia God dey?” Make Yu revensh dis pipol,
bikos dem don kill yor savants finish.
11 Make Yu listin to di prisonas kry.
Make Yu show yor great pawa
kon save doz wey pipol sey dem must die.
12 My God, make Yu pay awa neighbours seven times for di mout
wey dem don take boast for Yu.
13 Den, wi yor pipol, di sheep for yor field, go tank Yu forever
kon dey praiz yor name from one generashon go rish anoda.