85
Prayer For Di Nashon
Korah Shidren Song For Di Kwayamasta
My God, Yu don pour blessing and favor put for yor land
and give Israel en glory back.
Yu forgive yor pipol dia sins.
Yes! Yu kover all dia sins.
Yu nor dey vex for dem again
and Yu nor show dem yor vexnashon.
My God wey dey diliver us, make Yu save us again!
Make Yu nor dey vex for us!
Abi Yu go dey vex for us forever?
Yu go just dey vex even for awa shidren-shidren?
Yu nor go revive us again
so dat yor pipol go happy bikos of Yu?
My God, make Yu show us yor loyal love!
Pour yor salvashon for awa head!
I go listin to wetin Oga God tok,
bikos E go make peace with en pipol;
doz wey dey obey am,
so-far dem nor go-go back to dia wiked and yeye ways.
True-true, time dey kom wen pipol wey dey follow am well,
go si en salvashon; den en glory go appear for di land again.
10 Love wey nor dey fail and trut, don join togeda.
Raitiousness and peace don kiss each oda.
11 Trut dey kom out from di world and raitiousness dey smile
kom down from heaven.
12 Yes, God dey pour en blessings kom down,
so awa land go produce betta-betta food again.
13 Raitiousness dey go for God front
go prepare di way wey E go pass.