86
Prayer For Help
David Prayer
My God, make Yu hear my prayer;
make Yu ansa and help mi, bikos pipol dey opress mi.
Make Yu protet and save mi,
bikos na only Yu I dey serve and trust and na Yu bi my God.
Make Yu sorry for mi, my Oga God,
bikos I dey always koll yor name.
My God, make Yu make mi happy,
bikos I don give mysef to Yu.
Yu dey good and ready to forgive awa sins
and pipol wey kom meet Yu for help,
Yu dey show dem yor love wey nor dey fail.
So my God, make Yu listin well-well to my prayers;
make Yu kwik-kwik hear mi as I dey kry for help.
I go koll Yu wen ever I dey trobol and Yu go ansa mi.
My God, no oda god bi like Yu.
No one fit do wetin Yu dey do!
Oga God, all di nashons wey Yu make,
go kom bow down for Yu
and dem go praiz yor holy name,
10 bikos Yu big well-well
and dey do wonderful tins.
Na only Yu bi God,
11 so make Yu tish mi yor ways, so dat I go live my life as Yu wont am!
Make Yu give mi pure heart, so dat I go always dey honor Yu.
12 My Oga and God, I go praiz Yu with all my heart,
I go give glory to yor name forever,
13 bikos di love wey Yu get for mi,
big well-well and Yu don save mi from deat.
14 My God, wiked pipol dey raiz against mi; sturbon pipol dey won kill mi.
Yu nor mean anytin to dem!
15 But Yu, my Oga, Yu bi God wey dey sorry and pity for pipol;
Yu nor dey kwik vex and Yu dey show yor faithfulnes
and great love wey nor dey fail.
16 Make Yu turn face mi kon sorry for mi!
Make Yu give yor pawa to yor savant,
den diliver pipol wey dey obey Yu.
17 Make Yu show mi sign sey Yu go favor mi.
Den shame go katch di pipol wey hate mi,
bikos Yu wey bi my God,
don help and konfort mi.