87
Jerusalem Song
Korah Shidren Song
Di town wey God build by ensef,
dey for di holy mountin.
God love Jerusalem
pass any oda town for Israel.
Si as pipol dey tok good tins about yu Jerusalem
wey bi God town!
I go kount Egypt and Babilon
join di towns wey know mi.
I go still kount Filistia and Tyre
plus Ethiopia town join dem.
All of dem dey sey
dem born dem for Jerusalem!
But for Jerusalem real pipol, odas go sey,
“Una dey enjoy o-o, bikos una bi Jerusalem pipol.”
And di Most High God go bless di town by ensef.
Wen God dey kount and rite en pipol name for en book, E go sey,
“Dem born dis ones sef for Jerusalem.”
So di pipol go blow trumpet kon sing sey,
“Na Jerusalem bi di hope wey wi get!”